Nehemiah
-
Jeremiah Chapter 23
Di Pure Branch Wahala for di pastors wey dey scata di sheep (pipo) of my green-land (place of rest)!” Naso Baba-God tok. So na wetin Baba-God of Israel tok be dis, against di pastors wey dey feed my pipo: “Becos una don scata my pipo, con pursue dem komot, and una no gree take care of dem, I go use evil take punish una, becos of di evil tins wey una don do,” naso Baba-God tok. “Me by mysef go gada di remaining of my pipo from everi kontri wey I don pursue dem go, and I go carry dem come back to dia green-land, where dem go produce fruits,…
-
Nehemiah Chapter 13
Dem Separate Foreigners On dat day dem read di Book of Moses loud make everi pesin hear am, and dem see one page wey tok sey make dem no ever allow any Ammorite or Moabite gada wit Baba-God pipo forever. Becos dem no carry food and water come give di pipo of Israel—but dem pay Balaam to curse dem. (But awa God turn di curse to blessing.) E con happun sey wen di pipo hear dis law, dem separate all di pipo wey get foreigner blood from Israel. Before dis tin, Eliashib wey be di priest nahin dey in charge of di storerooms of Baba-God house. Eliashib and Tobiah…
-
Nehemiah Chapter 12
Priests plus Levites Na all dis be di priest plus di Levites wey come back wit Zerubbabel wey be di son of Sheatiel, and wit Jeshua: Seraiah, Jeremiah, Ezra, Amariah, Malluch, Hattush, Shecaniah, Rehum, Meremoth, Iddo, Ginnethon, Abijah, Mijamin, Moadiah, Bilgah, Shemaiah, Joiarib, Jedaiah, Sallu, Amok, Hilkiah, plus Jedaiah. Na dis be all di leaders of di priests plus all dia brodas for di days of Jeshua. Di Levites na: Jeshua, Binnui, Kadmiel, Sherebiah, Judah, plus Mattaniah—dem and dia brodas bin dey in charge of di songs of tanksgiving. Bakbukiah plus Unni, dia brodas—dey stand opposite dem for di service. And Jeshua nahin be di papa of Joiakim, Joiakim nahin…