Numbers Chapter 17
Aaron Walking-stick [staff] Start To Dey Grow
- Baba-God con tell Moses sey,
- “Follow di pipo of Israel tok and make you collect twelve walking-stick from dem, one from everi of di leaders of di tribe of dia ancestors. Write di name of everi man for dia walking-stick.
- Write Aaron name on Levi walking-stick, becos one walking-stick must dey for di head of everi tribe of dia ancestors.
- Put dem inside di worship-place, for front of di ark of Baba-God law, where I go meet una.
- Di walking-stick wey belong to di man wey I go choose go start to dey grow. Naso I go take stop di complain—wey dem dey complain against you.”
- So Moses follow di pipo of Israel tok, and dia princes give am twelve walking-sticks, for everi leader of all di tribes of dia ancestors, and Aaron staff dey among dem.
- Moses con put all di walking-stick for Baba-God front, for front of di worship-place.
- E con happun sey di next day, Moses enta di worship-place, con see sey Aaron walking-stick don dey grow, Aaron wey represent di house of Levi, and no be only sey e don dey grow, leaf don come out, flower don grow, and di almond fruit don dey ripe!
- So Moses carry all di walking-sticks komot from Baba-God front, he show dem to di pipo. Dem look dem, and everi man carry hin own walking-stick.
- Baba-God con tell Moses sey, “Put Aaron walking-stick back for front of di Ark, keep am for there as warning for pipo wey wan dey against Baba-God—sey dem go die unless dem stop to dey complain.”
- Moses do everitin wey Baba-God tell am.
- Di pipo of Israel con tell Moses sey, “We go die! Awa life go end, all of us go kpeme!
- Any pesin wey even come near di worship-place of Baba-God go die. Abi all of us go die?”