Obadiah
-
Obadiah Chapter 1
Di Judgement Of Edom Dey Come Di vision of Obadiah. Na wetin Baba-God tok about Edom: “We get message from Baba-God; messengers don go round di nations to tok sey, “Stand up and make we go fight against her!” “See, I don make una small among di nations; dem hate una well-well. Di buga wey dey inside una heart don scam una, una wey dey stay for high rock, and wey build una house for di high places, una wey dey tell unasef sey, ‘Who fit bring me down reach ground? Even though una dey fly high like eagle, con build una bird-house among stars, na from there I…