• Isaiah Chapter 19

    Message Against Egypt Blessings For Assyria, Israel Plus Egypt 18. On dat day, five of di cities of Egypt go speak di language of Canaan, and dem go swear to Baba-God Almighty. One of dis cities go be di city of Scata-scata [Heliopolis, di City of di Sun]. 19. On dat day, Baba-God altar go dey for di land of Egypt, and dem go build shrine for di border—to remember Baba-God. 20. E go be sign and witness to Baba-God Almighty for di land of Egypt, becos dem go cry to Baba-God becos of di pipo wey dey oppress dem, and he go send dem pesin wey go save dem,…