• Isaiah Chapter 22

    Words Against Jerusalem Di Judgement On Shebna 15. Dis na wetin Baba-God Almighty tok, “Go meet Shebna wey dey in charge of di palace, con tell am sey, 16. “Who you tink sey you be sef? And wetin you dey do for here, wey you dey carve beta grave for yoursef for high hill? 17. See, Baba-God wan carry una komot wit gragra, you wey be strong man, and he go surely gbab you. 18. He go throw you anyhow like ball, con throway you put inside kontri wey big well-well. You go die for there near di horse-moto wey dey make you feel-big. You be shame to your oga…