-
Isaiah Chapter 28
Di Judgement On Ephraim Di Foundation Stone For Zion 14. So make una hear Baba-God word, una wey be men of shame, wey dey rule dis pipo of Jerusalem. 15. Becos una don tok sey, “We don make agreement wit death, and we don make deal wit hell. Wen di serious punishment come, e no go ever touch us, becos we don make lie-lie awa strong-house, and we dey hide awa head inside fake-life.” 16. So Baba-God wey be awa Oga tok sey, “See, I dey put foundation stone for Zion, strong confam stone. Na beta foundation stone wey pesin fit build on top wit no shaking. 17. I go…
-
Isaiah Chapter 29
Wahala For Jerusalem Di Blindness of Disobeying 9. Stop and calm down to reason (reason dis prophecy)! If una like make una do like sey una close una eyes from di prophecy. Dem don high [jodogo] like mumu, but no be beer high dem; dem dey fall but no be ogogoro cos am. 10. Becos Baba-God don pour di spirit of deep sleep for una body, and he don close una eyes, di eyes of di prophets, and even una pipo wey sabi see visions. 11. Naso all of una visions don be like di word of book wey close, like book wey dem give pesin wey know-book, con…