• Isaiah Chapter 32

    Di King Wit Clean-Heart Di Women Of Jerusalem 8. But beta pipo dey plan good tins, and na good tins go make am stand. 9. Listen, women wey dey live easy life, hear my voice all dis babes wey dey do anyhow, listen to wetin I dey yarn. 10. Dis babes wey dey do anyhow—una go suffer for many days and years, becos una grapes no go dey again, and una harvest go stop. 11. Dis women wey dey live easy life, make una dey shake—una wey be ajebuta; Komot una clothes, con tie rags round una waist. 12. Beat your breast wit sadness, becos dem don scata di beta…

  • Isaiah Chapter 33

    Baba-God Level High Di Judgement Wey Dey Come On Zion 10. “Now I go rise,” naso Baba-God tok, “Now I go get levels; now I go carry mysef up. 11. Una go get-belle of chaff—con born grass: una own breath go turn to faya wey go burn una. 12. Di pipo go burn like lime, like shuuku-shuuku wey cut put for faya, naso dem go burn. 13. Una wey dey far-far hear wetin I don do, and una wey dey near—make una confam my pawa.” 14. Di sinners for Zion dey fear, fear-fear don surprise di pipo wey dey live fake-life. Dem tok sey, “Who among us fit stay wit…