• Isaiah Chapter 38

    Di Sickness of Hezekiah and As He Take Heal Hezekiah Song Of Tanks-giving 9. Di writing of Hezekiah wey be di king of Judah wen he bin dey sick, and hin body dey heal from di sickness. 10. I bin tok sey, “For di middle of my life, nahin I go go di land of di dead, and I no go live my life again.” 11. I tok sey, “I no go see Baba-God for di land of di living, I no go see man again wit di pipo wey dey stay for di world. 12. My life don komot, and e don move from me like shepherd tent for…

  • Isaiah Chapter 39

    Hezekiah Show Hin Beta-beta-tins Isaiah Predict Sey Dem Go Catch Babylon 3. So Isaiah di prophet come meet Hezekiah, he con tell am sey, “Wetin dis men tok? And from where dem take come meet you?” Hezekiah con tok sey, “Dem come meet me from Babylon wey be far-far kontri.” 4. So Isaiah tok sey, “Wetin dem see for your house?” Naso Hezekiah ansa am, “Dem see everitin wey dey for inside my house, e no get anytin among my beta-beta-tins wey I no show dem.” 5. So Isaiah tell Hezekiah sey, “Hear di word of Baba-God Almighty. 6. ‘See, day dey come wen everitin wey dey for inside your…