• Isaiah Chapter 40

    Make Road For Di Oga Baba-God Word Dey Stand Forever 6. Di voice tok sey, “Shout,” and he con tok sey, “Wetin make I shout?”  “All flesh na grass, and all e levels be like flower for field [wey dey fade]: 7. Di grass dey dry, and flowers dey fade, becos Baba-God Spirit dey blow am: surely di pipo be like grass. 8. Di grass dey dry, and flowers dey fade; but Baba-God word go stand forever. See Una God! 9. Oh Zion wey be messenger of good news, shout from on top of di mountain. Shout loud, oh Jerusalem wey dey bring good news. Shout and no let fear…

  • Isaiah Chapter 41

    Baba-God Epp For Israel Idols Wey No-make-sense 21. Baba-God tok sey, “Carry una argument come (for di idols wey una hand make).”  Di king of Jacob tok sey, “Make una bring una argument come (evidence of wetin dem fit do),” 22. Make dem bring dem come, con show us wetin go happun, make dem show tins wey don happun before-before—wetin dem be, so dat we go reason dem, con know wetin go happun las-las, or tell us wetin go still happun for future. 23. Show us wetin go happun lata, so dat we go know sey una be gods: Just do sometin—good or do evil, so dat we go see…