• Isaiah Chapter 44

    Baba-God Don Choose Israel Di Only One God 6. Naso Baba-God tok –wey be di king of Israel, and di Saviour, Baba-God Almighty, “Na me be di first and na me be di last, and apart from me no oda God dey. 7. Who fit be like me? Make he tok, con confam hin yarnings for my front. Make he do di tins wey I don do since olden days wen I make pipo, con tok about di tins wey go happun for future. 8. Make una no dey fear, or no let your mind dey cut: abi I neva tell una from dat time, and I no tok am?…

  • Isaiah Chapter 45

    Cyprus Na Baba-God Instrument Baba-God Na Di Only Savior 14. Naso Baba-God tok, “Di market of di Egyptians, plus di market of Ethiopians, and even di tall men of Seba—go come meet una, and dem go belong to una: Dem go follow una as prisoners for chains. Dem go kneel down for una front, con tok sey, ‘Baba-God true-true dey wit una, and nahin be di only God. No oda God dey.’” 15. True-true, you be God wey dey hide yoursef, oh Baba-God of Israel, wey dey save pesin. 16. Shame plus disgrace go catch all of dem. All of dem wey dey make idols go enta kata-kata togeda. 17.…