• Isaiah Chapter 48

    Israel Get Coconut-head Baba-God Promise To Save Israel 12. Make una hear me, oh Jacob plus Israel wey I don choose; na me be am; na me be di first and na me still be di last. 13. My hand sef nahin set di foundation of di earth, and my right hand nahin stretch di heavens: wen I call dem, dem dey stand up togeda. 14. Make all of una gada unasef and make una hear; which idol don bin tok dis tins? Baba-God don love am, and he go do wetin he like against Babylon, and hin hand go dey against di Chaldean. 15. Me, even me don yarn.…

  • Isaiah Chapter 49

    You Be My Servant Zion Go Dey Okay Again 8. Naso Baba-God tok, “For di right time nahin I don hear you, and for di days of salvation nahin I epp you. I go guard you, and I go give you as agreement for di pipo—to build di land wey don scata, and to make dem claim dia empty land. 9. To tell di prisoners sey, ‘Come outside,’ and to those pipo wey dey for darkness, ‘Come outside for light!’ Dem go be like sheep wey dey chop green grass for road, and dem go chop green grass for everi high hill. 10. Hungry no go catch dem and dia…