-
Isaiah Chapter 56
Baba-God Go Save All Nations Di Leaders of Israel Wey Dey Commit Sins 9. Make all di wild animals for di land come chop anyhow, make all di wild animals for forest come. 10. Hin watchmen dey blind, all of dem no sabi anytin (dem be olodo). All of dem na mumu dogs, dem no fit bark; dem dey sleep, dem dey lie down, dem dey enjoy make sleep carry dem go. 11. Yes dem be longatrot dog wey no fit belleful. Dis leaders no get any understanding. All of dem dey face dia own way. All of dem dey do only wetin dem fit gain from. 12. Dem go…
-
Isaiah Chapter 57
Israel Dey Follow Oda Gods In Vain Baba-God Dey Forgive Di Pipo Wey Repent 14. He go tok sey, “Make una build di road again! Komot di rocks and stone so dat my pipo go fit come back from di land wey dem dey serve as slaves.” 15. Baba-God wey dey up-up, wey get levels and wey dey live forever, di Holy One—tok sey, “I dey stay for high and holy place wit those pipo wey get humble spirit, and pipo wey dey feel bad wen dem do bad, and I go ginger di spirit of humble pipo and pipo wey get heart wey dey repent. 16. Becos I no…