• Isaiah Chapter 66

    Heaven Na My King-chair Jollificate Wit Jerusalem 7. “My holy city be like woman wey just born pikin wit-out labor. 8. Who don hear dis kain tins? Who don see dis kain tins? Abi di earth fit produce in one day? Abi na at onces dem go take born nation? Zion no go feel pain before new nation go born. 9. Abi I go bring baby reach di time wey hin mama wan born am, and I no go con make e mama born am?” Naso Baba-God dey ask. “Lai-lai! I no go ever stop dis new nation from coming out like new pikin,” Naso Baba-God tok. 10. Make una…

  • Jeremiah Chapter 1

                  Di Words Of Jeremiah Baba-God Call Jeremiah 4. Naso Baba-God word come meet me sey, 5. “Before I form you for your mama belle, I sabi you, and before you komot from your mama belle, I make you holy, con choose you as prophet for di nations.” 6. So I tok sey, “Ha, Oga, Baba-God! See, I no fit tok, becos I be small-pikin.” 7. But Baba-God con tell me sey, “No tok sey you be small-pikin: becos you go go meet all di pipo wey I go send you to, and you go tok anytin wey I tell you to tok. 8. Make you no fear dia face,…