-
Jeremiah Chapter 6
Jerusalem Last Warning Israel Disobey and Baba-God Change-am-for Dem 10. Who I go tok to, or who I go warn? Who go listen to me? See, dia ears no circumcise, and dem no go listen; see, Baba-God word be like shame to dem—e no dey make body sweet dem. 11. So I dey para well-well oh Baba-God, and I no fit hold am inside me. I go pour am out for all di pikin for street, and on all di young men wey gada, even on husbands plus wives, and on those pipo wey don old and wey dia head don white. 12. Oda pipo go claim dia house, togeda…
-
Jeremiah Chapter 7
Jeremiah Message For Di Gate Of Baba-God House Judah Kontinu To Dey Worship Idols 16. So Jeremiah, make you no pray for dis pipo, or beg me for dem, or epp dem pray, becos I no go listen to you. 17. Abi you no dey see wetin dem dey do to di cities of Judah, and for di streets of Jerusalem? 18. Di pikin gada wood, and di papa light di faya, and di women mix flour to make cakes for di queen of heaven, naso dem pour drink offering for dia gods—to make me vex. 19. Baba-God dey ask sey, “Abi na me dem dey make vex? Abi no…