-
Jeremiah Chapter 8
Judah Sin Plus Punishment Jeremiah Cry For Hin Pipo 18. I go try to calm down inside my sadness. My heart don faint inside me. 19. Hear di voice of di cry of my pipo from abroad: “Abi Baba-God no dey for Zion? Abi her king no dey for there again? ”But Baba-God ansa dem, “Why dem don make me vex wit dia idol, and wit dia mumu foreign gods?” 20. (Naso di pipo con tok sey,) “Harvest don pass, and cold season don end, and we no dey saved,” 21. Di pain of my pipo na my pain. I dey feel sad and I just dey wonder. 22. Abi…
-
Jeremiah Chapter 9
Disobedience Dey Bring Baba-God Punishment Cry-cry For Inside Jerusalem 17. Na wetin Baba-God Almighty tok be dis, “Make una reason, con go call di women wey sabi cry; di ones wey sabi cry pass. 18. Make dem come sharply, to cry for us till awa eyes full wit tears, and water start to dey rush komot from awa eyes. 19. Di voice of cry-cry loud from inside Zion: ‘Awa own don finish kpatakpata! Awa shame big well-well, becos we don fashi di land, becos awa house don scata finish.’ ” 20. So I tok sey, “Now, oh women, make una hear Baba-God word; open your eyes to wetin hin mouth…