-
Jeremiah Chapter 15
Judgement Go Kontinu Jeremiah Complain To Baba-God 10. Wahala for me! Chai my mama! Why my mama bring me come dis world? I always get wahala wit everi pesin for di land. I no dey owe any pesin moni, and no pesin dey owe me moni; but everi pesin dey curse me. 11. Baba-God con tell me sey, “Surely e go beta for una remaining pipo, and your enemies go beg you for epp wen wahala come and wen kasala burst. 12. No pesin fit break iron, especially iron from di north wey dem mix wit bronze. 13. I go give una beta-beta-tin plus una properties to oda pipo wey…
-
Jeremiah Chapter 16
Jeremiah Life plus Hin Message Baba-God Go Bring Back Israel 14. Baba-God tok sey, “But days dey come, wen men no go swear again wit di name of di living God wey carry di pipo of Israel komot from Egypt; 15. But dem go swear wit di name of di living God wey carry di pipo of Israel komot from di land of di north, and out of all di kontris where he pursue dem go.’ Becos I go carry dem enta di land again—wey I bin give dia papa-papa-papa. 16. Baba-God tok sey, “See, I go send plenty enemies wey go catch dem like fish, and wey go hunt dem…