• Jeremiah Chapter 17

    Di Sin Plus Punishment of Judah Jeremiah Pray For Healing 14. Heal me, oh Baba-God, and I go heal; save me and I go save—becos na you I dey praise. 15. Dem dey always tell me sey, “Where Baba-God word dey? Make e happun now!” 16. As for me, I neva stop to be pastor wey dey follow you; you know sey I no wish for bad days (days of judgement). You don hear everitin wey I tok, I tok dem for your front. 17. No turn to gbege for me; na you be my hope for di day of wahala. 18. Make shame catch di pipo wey dey show…

  • Jeremiah Chapter 18

    Di Pot-maker Plus Di Clay Dem Shenk Baba-God Warning 12. But dem go ansa sey, ‘No need. We go kontinu awa ways, everi one of us go do wetin dem dey reason for dia heart.’ 13. So na wetin Baba-God tok be dis: ‘Ask di nation: Who don ever hear sometin like dis? Serious tufiakwa nahin my virgin daughter Israel don do. 14. Abi snow dey ever disappear from on top of di mountains of Lebanon? Abi di cold water wey dey flow from far-far mountains dey ever dry? 15. But my pipo don forget me; dem dey burn incense to mumu idols, wey make dem fall for dia ways…