• Jeremiah Chapter 25

    Seventy Years As Prisoners of War Judgement For Di Nations 15. Na wetin Baba-God, di Oga of Israel tell me: “Carry dis cup of ogogoro of my vex wey dey for my hand, and make all di nations wey I go send you go meet—drink am. 16. Wen dem drink am, dem go stagger and dem go mad, becos of di sword wey I go send to dem.” 17. So I carry di cup from Baba-God hand and make all di nation wey he send me go meet—drink am: 18. Jerusalem plus di cities of Judah, dia kings, plus all dia princes—to scata dem, and make pipo shock for dem,…