-
Jeremiah Chapter 31
Cry-cry Turn To Happiness Baba-God Mercy 15. Na wetin Baba-God tok be dis: “Dem go hear voice for Ramah, cry-cry and serious sadness, Rachel dey cry for all her pikin, and she no go gree make pesin cool her down, becos all her pikin no dey again.” 16. Na wetin Baba-God tok be dis: “Stop your voice from cry-cry, and stop your eyes from tears: becos your works go get reward—naso Baba-God tok; and dem go come back again from di land of di enemy. 17. And hope dey for una future,” na wetin Baba-God tok, “Una pikin go come back to dia own land. 18. I don surely hear…
-
Jeremiah Chapter 32
Jeremiah Buy Land Jeremiah Prayer For Understanding 16. Afta I don give di documents to Baruch wey be di son of Neriah, I pray to Baba-God: 17. “Ah, Baba-God Almighty, na you make di heavens plus di earth wit your ogbonge pawa, and your hand wey stretch out. Notin dey too hard for you. 18. You dey show soft-love to thousands, but you dey punish even di next generation for di sins of dia papa. Oh ogbonge God wey get pawa, Almighty God na hin name. 19. Your plans na ogbonge and your works na elele. Your eyes dey open to all di ways of men; you dey reward everi…