-
Jeremiah Chapter 33
Promise of Peace Plus Prosperity Di Agreement Wit David 14. Baba-God tok sey, “Days dey come wen I go do my beta promise wey I make to di house of Israel plus di house of Judah. 15. For those days and for dat time, I go make correct branch grow from David; he go do di right tins and justice for hin land. 16. For those days, Judah go save and Jerusalem go live wit safety. Make dem call her wit dis name: ‘Baba-God awa goodness.’ ” 17. Becos dis na wetin Baba-God tok: “David go always get man wey go sidon for di king-chair of Israel, 18. And di…
-
Jeremiah Chapter 34
Prophecy Against Zedekiah Freedom For Hebrew Slaves 8. Baba-God message come meet Jeremiah afta king Zedekiah don make agreement wit all di pipo wey dey for inside Jerusalem, to announce freedom for di slaves. 9. Everi pesin suppose free hin Hebrew slave, both man and woman; no pesin suppose hold hin fellow Jews as slave. 10. So all di princes and di pipo wey do di agreement, gree sey dem go free dia man and woman slave, and dem no go take dem as slave again. Dem gree, con free dem. 11. But dem change dia mind lata, con carry dia slaves wey dem bin free, con turn dem to…