-
Jeremiah Chapter 37
Jeremiah Warn Zedekiah Dem Put Jeremiah For Inside Prison 11. E con happun sey, afta di army of Babylon don komot from Jerusalem becos dem dey fear Pharaoh army, 12. Naso Jeremiah start to dey komot from di city to go di area of Benjamin to go claim hin property among di pipo for there. 13. But wen he reach di gate of Benjamin, di captain of di guard wey hin name na Irijah, di son of Shelemiah, di son of Hananiah, con arrest Jeremiah. He tok sey, “You dey run go meet di pipo of Babylon!” 14. Jeremiah con tok sey, “No be true, I no dey run go…
-
Jeremiah Chapter 38
Jeremiah For Inside Di Underground Prison Dem Free Jeremiah 7. But Ebed-melech wey be Ethiopian, wey be official for di king palace hear sey dem don put Jeremiah inside pit. As di king dey sidon for di Benjamin Gate, 8. Naso Ebed-melech go di king palace, con tell am sey, 9. “My oga di king, dis men don do wicked tin for everitin wey dem don do to Jeremiah di prophet. Dem don throway am inside pit where hungry go catch am die, and bread no dey for di city again.” 10. So di king tell Ebed-melech di Ethiopian sey, “Take thirty men wit you from here, go carry prophet…