-
Jeremiah Chapter 51
Serious Judgement Against Babylon Song of Praise To Baba-God 15. “He make di earth wit hin pawa; na hin wisdom he take stand di world gidigbam, and na hin understanding he take stretch out di heavens. 16. Wen he raise hin voice, di plenty water wey gada for heaven dey shake. He dey make cloud raise from di ends of di earth. He dey make lightning for di rain, and he dey bring out strong-breeze from Hin store. 17. “Everi man no-get-sense and dem no sabi anytin; shame dey catch everi goldsmith for hin idols. Hin images na scam; dem no fit breath. 18. Dem be useless tins, na…
-
Jeremiah Chapter 52
As Jerusalem Take Fall Dem Burn Baba-God House Plus Di City 12. On di tenth day of di fifth month, for di nineteenth year of Nebuchadnezzar as king of Babylon, Nebuzarandan wey be di commander of di guard, wey dey work for di king of Babylon, con enta Jerusalem. 13. He burn Baba-God house, di king palace, plus all di houses for Jerusalem; and he burn all di houses of di strong men—wit faya. 14. Naso all di sojas of di Chaldeans wey dey wit Nebuzarandan—dia commander, con break all di walls wey dey round Jerusalem. 15. So Nebuzarandan wey be di commander of di guard, con carry some of…