-
Ezekiel Chapter 2
Baba-God Call Ezekiel
-
Ezekiel Chapter 3
Ezekiel Chop Di Book Watchman For Israel 16. Wen di seven days reach, Baba-God word come meet me, sey: 17. “Man pikin, I don turn you to watchman for di pipo of Israel; so hear di words wey I dey tok and warn dem for me. 18. Wen I tell wicked man sey, ‘You go surely kpeme,’ and you no gree warn am, or tok out [soro-soke] to make am komot hand from hin evil ways—so dat you go fit save hin life—dat wicked man go kpeme inside hin sins, but I go hold you for hin blood. 19. But if you warn di wicked man and he no gree…