• Ezekiel Chapter 11

    Judgement On Israel Leaders Di Promise To Bring Israel Back Again 14. Naso Baba-God word come meet me again sey: 15. “Man pikin, your brodas—your brodas wey be your blood relatives, plus di whole house of Israel wey una dey togeda for foreign land so—na dem be di pipo, wey di pipo wey dey stay for Jerusalem now—dey tok about sey, ‘Make una dey far from Baba-God; Baba-God give us dis land as awa property.’ 16. So tok sey, ‘Dis na wetin Baba-God Almighty dey tok: Even though I send dem far-far komot among di nations, con scata dem among di kontris, but for short time, I go be like…