• Ezekiel Chapter 16

           Jerusalem Na Wife Wey No Dey Faithful Jerusalem Na Ashawo 31. You build shrines for front of everi road, you build shrines for idols for everi street, con dey do like ashawo. Evensef, you no be like normal ashawo, becos you no dey ask for moni. 32. You be ashawo wife wey prefare strangers instead of your own husband wey love you! 33. Everi olosho dey collect moni, but you be oshofree for all men, you dey pay dem make dem come meet you from everi where, to come sleep wit you. 34. So inside your ashawo, you be di opposite of odas; na you dey pay your customers, instead…

  • Ezekiel Chapter 17

    Two Eagles plus One Vine Tree Israel Get Levels At Las 22. Dis na wetin Baba-God Almighty tok: “I go cut one of di highest branch komot from di tall cedar tree—con plant am, I go break new branch from up-up, branch wey soft, con plant am on top of one high mountain. 23. For di mountain wey tall pass for Israel nahin I go plant am. E go be fine cedar tree wey dey send e branches go out, con dey produce fruit. Different-different type of birds nahin go build dia bird-house put, and dem go live for di shade of di branches. 24. Naso all di trees for…