• Ezekiel Chapter 20

    Israel Turn Against Baba-God Baba-God Dey Punish, But He Dey Forgive 30. “So tell di pipo of Israel sey: ‘Dis na wetin Baba-God Almighty tok: “Abi una go corrupt unasef di way una papa-papa-papa take corrupt demsef, con dey follow dia evil idols like ashawo? 31. Wen una dey give una gifts—di sacrifice of una sons for inside faya—una dey corrupt unsef wit all una idols till today. Abi I go let una ask me about anytin, oh pipo of Israel? As surely as I dey live, I no go let una ask me about anytin,’ naso Baba-God Almighty tok. 32. Una tok sey, ‘We wan be like di nations,…

  • Ezekiel Chapter 21

    Babylon Na Baba-God Sword Sword Against Di Ammonites 28. “And you, man pikin, prophesy and make you tok sey, ‘Dis na wetin Baba-God Almighty tok about di Ammonites plus  dia insults,’ and tok sey: ‘Sword, dem don carry sword wey go kill una,  sword wey dem polish to kill, and wey dey flash like lightning— 29. Una prophets dey see fake vision and dem dey tell una fake prophecies. Una be wicked and evil pipo, and una cup don full, di days of una final punishment dey come. Na sword go fall for una necks. 30. Your days of punishing odas don end, so keep your sword. I go judge…