-
Ezekiel Chapter 22
Di Sins of Jerusalem Israel For Inside Hot-hot-faya 17. Naso Baba-God word come meet me, con tell me sey: 18. “Man pikin, di house of Israel don turn to waste from iron—for my eyes; all of dem be like bronze, tin, iron, plus lead—for inside di faya; dem even be di waste iron for inside silver. 19. So dis na wetin Baba-God Almighty tok: ‘Becos all of una don turn to waste iron, see, I go gada una enta Jerusalem. 20. As men take dey gada silver, copper, iron, lead plus tin enta faya to melt am wit hot faya, naso I go gada una as I dey vex and…
-
Ezekiel Chapter 23
Two Ashawo Sistas Di Senior Sista, Samaria 5. “Oholah start to dey do ashawo wen she still belong to me; and she run follow men, di Assyrians wey be her neighbours. 6. Dem dey wear blue cloth, dem be govnors plus commanders, all of dem na fine young guys wey dey ride horse. 7. She give hersef as ashawo to dem—to all di top men of Assyrians, con corrupt hersef wit all di idols of everi man wey she dey follow. 8. She no stop her ashawo work wey she start for Egypt. Pipo sleep wit her wen she small, dem press her breast, con use her cure dia konji…