• Ezekiel Chapter 34

    Shepherds Wey No Dey Do Dia Work Baba-God Na Di Real Shepherd 11. ‘Dis na wetin Baba-God Almighty tok: “Me mysef go look for my sheep, and I go fyne dem. 12. As shepherd take dey fyne hin sheep on di day wey he dey among di sheep wey don scata, naso I go take fyne my sheep. I go save dem from all di places where dem scata put—for di dark day wen clouds cover di sky. 13. I go carry dem come out from di nations, con gada dem from all di kontris, and I go carry dem enta dia own land. I go give dem green-land to…