• Ezekiel Chapter 39

         Di Killing Of Gog Armies Di Burial Of Gog 11. “And e go happun on dat day sey, I go give Gog burial ground for inside Israel, for bottom-of-di- mountain of those wey dey travel, for di east side of di big-river. E go block di road of pipo wey dey travel, becos dem go bury Gog plus all hin plenty sojas for there. So dem go call am, ‘Bottom-of-di-mountain of Hammon-gog.’ 12. Di pipo of Israel go bury dem for seven months, so dat dem go fit clean di land. 13. All di pipo wey dey for di land go bury dem, and di day of my levels…