• Daniel Chapter 2

    Nebuchadnezzar Dream Baba-God Show Daniel Di Dream 14. Wen Arioch wey di commander of di king guard komot to kill all di wise men for Babylon, Daniel follow am tok wit wisdom. 15. So he ask di king commander sey, “Why di king rush sign dis hard law?” Naso Arioch explain di mata to Daniel. 16. So Daniel go meet di king, con beg am for more time, so dat he go fit tell am di meaning of di dream. 17. Naso Daniel go back to hin house, con explain di mata to all hin padi; Hananiah, Mishael, plus Azariah. 18. He beg dem sey make dem beg Baba-God of…

  • Daniel Chapter 3

           Nebuchadnezzar Golden Image Shadrach, Meshach, Plus Abednego 8. Around dis time, some of di men wey sabi read stars come front, con put mata for di Jews head. 9. Dem con tell king Nebuchadnezzar sey, “Oh king, make you live forever! 10. You don make law sey everi pesin wey hear di sound of di horn, flute, harp, lyre, and psaltery, plus everi kind of music instrument, must bow down face ground, con worship di image of gold, 11. And any pesin wey no bow down face ground (dobale), con worship, make dem throway am inside hot-hot faya. 12. But he get some Jews wey you don choose to…