• Daniel Chapter 4

    Di Second Dream Daniel Explain Di Second Dream 19. Naso Daniel wey dem dey call Belteshazzar con shock for one hour, becos of di meaning of di dream. So di king tok sey, “Belteshazzar, no let di dream or di meaning of di dream make you shock.” Belteshazzar ansa am, con tok sey, “My oga, I wish sey di dream na for your enemies and di meaning na for badbelle pipo. 20. Di tree wey you see, wey grow, con strong; wey high reach sky, and wey di whole earth fit see, 21. wit fine leaves and fruits wey burku, wey dey provide food for everi pesin, and wey dey…

  • Daniel Chapter 5

    Di Writing For Wall Daniel Explain Di Writing 13. So dem carry Daniel come meet di king, and di king tell am sey, “Na you be Daniel, one of di foreigners wey my papa di king carry come from Judah? 14. I don hear sey di spirit of di gods dey for inside you, and I hear sey you fit see-far, you sabi tins, and you understand wisdom. 15. Dem don carry di wise men come, wit all di pipo wey sabi read stars, sey make dem read dis writing, con tell me wetin di writing mean, but dem no fit explain am. 16. Now I don hear sey you…