Proverbs Chapter 13
Wise Pikin Dey Hear Hin Papa Word
- Pikin wey get-sense dey hear wetin hin
papa dey teach am, but mugu no dey listen wen dem dey correct am. - Na wetin man dey tok from hin lips nahin
dey make am chop-life, but wicked pipo soul
dey drink blood. - Any-pesin wey dey guard hin lips dey
guard hin life, but any-pesin wey dey open
hin mouth to tok anyhow go kpeme. - So lazy pesin no-fit get wetin hin soul want,
but pesin wey dey hustle wella—go get-
moni. - Good man hate lie-lie, but yeye dey smell
follow badbelle pipo, and na disgrace dey
wait for am. - Na goodness dey guard di man wey get
beta character, but wickedness dey overthrow
sinners. - One man dey form sey he get moni, but he
no get shi-shi; anoda man dey form sey he
poor, but he get moni well-well. - Rich man moni fit save hin life, but poor
man no dey hear if dem threaten am. - Good man light dey shine well-well, but
wicked man lamp go blow komot. - To feel-big only dey bring quarrel, but
wisdom dey wit pipo wey dey hear advice
well- well. - Mago-mago moni go fly komot, but any-
pesin wey dey gada moni from hin
hustle—dey make moni grow. - Hope wey fail—be like heart attack, but
wen pesin get wetin he wish for—e be like
tree of life. - Pesin wey fashi di word—go kpeme, but
any-pesin wey respect wetin dem teach
am—go succeed. - Wise man teaching na water of life—wey
dey turn pesin komot from death trap. - Beta understanding dey win favour, but
unfaithful pipo way na suffer-head. - Everi wise man dey do tins based-on
wetin dem know, but swegbe dey always
show sey e be ode. - Wicked messenger dey enta wahala, but
messenger wey dem trust dey bring healing. - Poverty and shame go catch pesin wey
fashi correction. But any-pesin wey hear
correction go get levels. - Di soul dey happy wen
he get wetin he wish for, but mumu pipo dey
forbid to change from evil. - Pesin wey follow wise man waka—go
wise, but kasala go burst for mumu pipo and
dia padi. - Evil dey pursue sinners, but prosperity na di pay of pesin wey get clean-heart.
- Good man dey leave properties for hin
pikin-pikin, but sinners dey gada moni for
good pipo. - Poor man farm fit produce plenty food,
but e go turn to waste becos justice no dey. - Pesin wey no dey punish hin pikin no like
di pikin, but pesin wey love hin pikin dey
correct am sharp-sharp. - Good man dey chop sote dia heart go
belleful, but badbelle pipo belle go empty.