Proverbs Chapter 26

Abeg share

Levels No Fit Mumu

  1. Like snow for hot season, or rain for
    harvest, naso respect no-fit mugu.
  2. Like birds wey dey fly komot, naso curse
    wey no be for pesin—no go fit fall on am.
  3. Flogging na for horse, rope na for donkey,
    and koboko for mumu back!
  4. No ansa mumu based- on hin level, or
    yousef go be mumu like am.
  5. Ansa mumu in a mumu way, or he go tink
    sey he wise.
  6. To send dondi message be like sey, make
    pesin cut hin leg komot, and drink fight-fight.
  7. Proverb for swegbe mouth, be like useless
    leg wey paralyze.
  8. To give mugu respect—be like make pesin
    tie stone for catapult.
  9. Like shuku-shuku for drunkard hand, naso
    proverb be for mumu mouth.
  10. Di ogbonge God wey make everitin dey
    give mumu pipo dia pay, and he dey pay evil
    pipo dia salary.
  11. As dog take dey go back to chop e vomit,
    naso mumu pipo take dey repeat dia yeye
    way.
  12. Abi you neva see man wey tink sey he
    wise for hin own eyes? Swegbe get hope
    pass am.
  13. Lazy man go tok sey, “Lion dey for road,
    lion wey dey para dey patrol for street!”
  14. As door take dey open wit e hinges, naso
    lazy man take dey go sleep for bed.
  15. Lazy man go put hin hand for plate, but
    hin hand dey heavy am to carry put for hin
    mouth.
  16. For lazy man eyes, he wise pass seven
    men wey dey reason well.
  17. Pesin wey dey waka pass, wey con
    shuuk-mouth for mata wey no concern am,
    be like mumu pesin wey go drag dog for e
    ear.
  18. Like craseman wey dey shoot arrow of
    faya, sharp arrow, plus death,
  19. naso pesin wey dey scam hin neighbour
    be—he go con tok sey, “Na play I dey follow
    you play!”
  20. Faya go quench if faya- wood no dey;
    quarrel go end if aproko no dey.
  21. As charcoal be to coal wey dey burn, and
    as wood be to faya, naso man wey like
    kwanta dey put faya for quarrel.
  22. Aproko words be like small sweet food
    wey dey enta body.
  23. Like polish wey dey cover clay pot, naso
    sweet-mouth wey dey hide bad-mind be.
  24. Evil pesin dey pretend wit hin
    words—but na mago-mago full hin heart.
  25. Even though he tok wit kindness, no
    believe dem. Na seven tufiakwa dey for hin
    heart.
  26. Even though he cover hin badbelle wit
    wayo, but hin wickedness go cast for where
    pipo gada.
  27. Man wey dig pit—go fall inside di pit,
    and pesin wey roll stone, di stone go roll
    back on am.
  28. Pesin wey dey tok lie, hate di pesin wey
    he dey lie on top hin head, and mouth wey
    dey hail pesin dey spoil tins.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *