Proverbs Chapter 27
No Dey Make-mouth About Tomorrow
- No dey make-mouth about tomorrow,
becos you no know wetin di day go carry
come. - Make anoda pesin praise you—no dey
praise yoursef; make e be pesin wey no know
you, no be from your own lips. - Stone heavy and sand get weight, but wen
mugu para—e dey heavy pass di two of dem. - Vex no good, and to para be like wave, but
who fit stand
jealousy? - E beta make pesin correct you for where
everi-pesin dey, dan make pesin show you
love for secret. - E beta make your correct padi wound you,
but kiss from your enemy na wayo. - Pesin wey don belleful go hate honey, but
even sometin wey bitter—dey sweet for
hungry pesin mouth. - Like bird wey don fly komot from e bird-
house, nahin be man wey run komot from
house. - Ororo and perfume dey make heart jolly,
naso beta advice of correct padi dey make
heart jolly. - No fashi your padi and your papa padi,
and no dey go your broda house only wen
yawa gas—neighbour wey dey near beta
pass broda wey dey far-far. - Wise up my pikin, and make my heart
happy; so dat I go fit ansa pesin wey dey yab
me. - Man wey get-sense go see danger, and he
go hide hin head, but mumu go still dey
carry- go and he go suffer am. - Collect collateral from pesin wey go do
guarantor for jjc; hold hin property if he do
am for strange woman. - If man dey raise hin voice anyhow—dey
bless hin neighbour for early mor-mor, pipo
fit go reason am as curse. - Woman wey like quarrel—be like rain
wey dey fall small-small—wey no wan gree
stop. - To control her be like sey you wan catch
breeze, or e be like sey you wan hold ororo
wit your hand. - As iron take dey sharp iron, naso man take dey sharp anoda man mind.
- Any-pesin wey take care of tree—go
chop from e fruit, and any-pesin wey serve
hin oga go get hin pay. - As water take dey show pesin face like
mirror, naso man heart take dey show as di
man really be. - Death and grave no dey belleful, naso
man eyes sef no dey belleful. - Na heat dem take dey shine silver plus
gold, but na wetin oda pipo dey tok about
pesin nahin dey give am levels. - Even if you grind mugu for mortar wit
pestle—like seed, hin yeye ways no go still
komot from am. - Make sure sey you dey take care of your
animals, look your animals well-well; - becos moni no dey last forever, and
crown no dey last for all generations. - Wen dem don cut di grass, and new ones
don dey grow, and dem harvest all di herbs
from di hills, - di sheep go provide una wit cloth, una go
use di moni from una goats—take buy land. - You go get enuff milk to feed you and
your family, and your house-girls.