Proverbs Chapter 28

Abeg share

Good Man Get-mind Like Lion

  1. Badbelle pipo dey run wen no-pesin dey
    pursue dem, but good pipo get-mind like
    lion.
  2. Kontri wey dey commit sin dey get plenty
    rulers; but man wey get knowledge and
    understanding go maintain di right tins.
  3. Poor man wey dey oppress poor man be
    like heavy rain wey dey scata farm.
  4. Those pipo wey dey fashi di law dey cut-
    cap for wicked pipo, but pipo wey dey keep
    di law dey change-am-for wicked pipo.
  5. Evil men no understand justice, but those
    pipo wey dey follow Baba-God understand
    everi-everi.
  6. Poor man wit clean-hand—beta pass
    bigman wey no get clean-hand.
  7. Any-pesin wey dey keep di law—na pikin
    wey get- sense, but di padi of pipo wey get
    longatrot—dey disgrace dia papa.
  8. Pesin wey dey charge high interest, and
    wey dey obtain pipo—just dey gada hin
    moni for anoda pesin wey go show love to
    poor pipo.
  9. Any-pesin wey fashi di law, even hin prayers na tufiakwa.
  10. Pesin wey carry beta pesin miss-
    road—con follow bad way—hinsef go fall
    inside hin own pit, but pesin wey get clean-
    heart—go get beta blessings.
  11. Bigman fit tink sey he wise for hin own
    eyes, but poor man wey get understanding
    dey see all hin way.
  12. Wen good man win, pipo go happy well-
    well, but wen wicked man rise, pipo dey
    jakpa.
  13. Any-pesin wey dey cover hin mistake no
    go grow, but any-pesin wey accept hin
    mistake, con tok sey he no go do dem
    again—go receive mercy.
  14. Blessings for di man wey dey always fear
    Baba-God, but pesin wey get strong
    heart—go fall enta kasala.
  15. Like lion wey dey shout, or bear wey dey
    para, naso wicked
    ruler be to poor pipo.
  16. Mumu leader dey oppress hin pipo well-
    well, but pesin wey hate longatrot go live
    long.
  17. Man wey hin spirit dey disturb am becos
    he shed blood—go run enta pit; and make
    no-pesin epp am.
  18. Pesin wey get clean- heart—go dey safe,
    but pesin wey hin way no straight—go fall
    before you know.
  19. Pesin wey hustle for hin land—go get
    plenty food, but pesin wey dey use hin life
    play—go poor well-well.
  20. Faithful man go get blessings burku, but
    pesin wey hin eyes dey shuuk to make moni
    sharp-sharp—no go escape punishment.
  21. E no good make pesin dey do
    partiality—but men dey do wrong tin becos
    of chikini bread.
  22. Man wey hin eyes dey shuuk wan make
    sharp-sharp moni, he no dey reason sey na
    poverty dey wait for am.
  23. Pesin wey correct pesin go get more
    favour las-las—pass pesin wey just dey hail
    pesin wit sweet-mouth.
  24. Any-pesin wey rob hin mama or papa con
    tok sey, “No be wrong tin”—be like di padi
    of pesin wey dey scata tins.
  25. Man wey dey feel-big for hin heart—dey
    cos quarrel, but any-pesin wey trust Baba-
    God go prosper.
  26. Any-pesin wey trust hin own heart na
    mumu, but pesin wey dey waka wit common
    sense—go dey safe.
  27. Any-pesin wey dey give poor pipo go always get enuff, but any-pesin wey dey throway-face from poor pipo—go receive plenty curse.
  28. Pipo dey run go hide wen wicked pesin
    get pawa, but good pipo go shine wen
    wicked man kpeme.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *