Proverbs Chapter 29
Happiness For Di Man Wey Dey Keep Di Law
- Pesin wey no wan gree change afta plenty
pipo don warn am—go soon fall, and notin
go fit save am again. - Wen beta pesin dey rule, pipo go dey jolly;
wen wicked men dey rule, pipo go dey cry. - Any-pesin wey love wisdom dey make hin
papa happy, but pesin wey get plenty ashawo
as hin padi—go waste hin moni finish. - Na wit justice king take dey maintain hin
kontri, but king wey get longatrot for egunje
(bribe) go bring hin kontri down. - Any-pesin wey dey whyne hin neighbour
wit sweet- mouth dey set trap for am. - Evil man sin go catch am like trap, but
good man go sing and jolly. - Good man dey reason justice for poor
pipo, but wicked man no understand dat kain
mata. - Mumu pipo fit cos faya for full city, but
wise men dey make pesin wey dey
vex—cool down. - If wise man dey argue wit mugu, di mugu
go dey para and dey laff, and settlement no
go dey. - Men wey like to shed blood—hate men
wey get clean- hands, but good men dey fyne
way to epp pipo wey get clean-hands. - Mumu pesin dey show hinsef wen he dey
vex, but wise man dey control hinsef. - If Igwe (King) dey listen to lies, all hin
officials go wicked well- well. - Poor man and pesin wey dey oppress am
resemble demsef; na Baba-God dey give dia
eyes light. - King wey dey judge poor pipo wit truth,
hin king-chair go last forever. - Punisment plus correction dey make
pesin wise, but pikin wey dem just leave like
dat—go fall hin mama hand. - Wen wicked men dey shine—sin sef go
shine, but good man go see as dem go take
fall yakata. - Correct your pikin, and dem go give you peace; eehn…e go make your soul jolly.
- Where vision no dey, di pipo go kpeme;
but blessings for di pesin wey dey keep di
law. - You no-fit just use ordinary tok take
correct your servant; even if he understand,
he no go ansa you. - Mugu get hope pass man wey no dey
reason before he tok. - Servant wey pesin dey pet from small go
turn to hin pikin las-las. - Man wey dey vex—dey cos quarrel, and
pesin wey dey para go do plenty wrong tins. - Man wey dey carry- shoulder-up go fall,
but man wey dey do jeje—go gain respect. - Pesin wey epp tiff, hate hin own life, he
don swear to tok true, but he no-fit tok
anytin! - To dey fear man—na trap; but any-pesin
wey trust Baba-God go dey safe. - Plenty pipo wan meet king for epp, but
justice for man—dey
come from Baba-God. - Good man no like pesin wey dey lie;
wicked pipo no like pesin wey get clean-
hand.