Proverbs Chapter 5

Abeg share

Warning Make You No Climb Pesin Husband Or Wife

  1. My son, put your ear for ground—hear my
    wisdom, listen well-well to my
    understanding,
  2. so dat you go fit keep common sense, and
    your lips go tok knowledge.
  3. Honey dey drop from ashawo lips, and her
    words smooth pass ororo.
  4. But las-las, she bitter well-well like
    poison, and she sharp like sword wey get two
    sides.
  5. Her leg dey waka go kpeme, her road dey
    go straight to grave.
  6. So dat you no go reason her life, her way
    no straight, sote you no-fit understand dem.
  7. Now my pikin, make you hear me now; no
    fashi wetin I dey tok.
  8. Waka far from where she dey! No go near di doormot of her house,
  9. or you go give your star to oda pipo, con
    waste your life wit badbelle pipo,
  10. or jjc (strangers) go chop your moni plus
    your properties, and your hustle go go
    foreigner house.
  11. Las-las, you go dey cry, wen your skin
    and your body don dry.
  12. You go tok sey, “See as I bin hate to learn
    sometin! And my heart fashi correction.
  13. I no gree obey my teachers, and listen to
    di pipo wey dey teach me.
  14. My life don almost scata finish—for
    front of everi-pesin.
  15. Drink water from your own tank, and
    water wey dey flow from your own well.
  16. Abi your water dey scata for everi-where,
    and di stream of your water dey flow for
    street?
  17. Keep am only for yoursef, and no share
    am wit jjc.
  18. Make your water dey blessed. And happy
    wit di woman wey you marry for young age.
  19. As fine deer and beautiful like
    doe—make her breast always belleful you,
    and make her love always blow your mind.
  20. My pikin why you wan allow ashawo tiff
    your heart? Why you dey gum-body wit
    olosho?
  21. Baba-God dey watch all man ways, and
    he dey reason all hin ways.
  22. Di bad tins wey badbelle pipo dey do
    nahin dey catch dem, and hin sins go hollam
    like rope.
  23. He go kpeme becos he no dey hear word,
    hin ogbonge kolomentality nahin go make
    am miss-road.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *