Proverbs Chapter 6
Warning Make You No Be Mugu
- My son, if you don stand as guarantor for
your padi, if you don agree to be guarantor
for jjc, - if wetin you tok don hold-you-for-work,
or your mouth don catch you, - make you do dis tin my son, and free
yoursef—becos you don fall inside your padi
hand. Go, con humble yoursef. Beg your
padi! - No close your eyes con sleep, no let sleep
carry you go. - Free yoursef, like bush- meat from hunter
hand, and like bird from hunter hand. - Chai lazy man; go meet ant, reason dem and make you get- sense!
- Dem no get oga, chairman, or oba wey dey
rule dem, - but dem dey keep dia food for dry season,
and dem dey gada dia food for harvest. - How long you go dey sleep, chai lazy
man? Wen you go stand up from your sleep? - Make I sleep small, make I chill small,
make I fold my hand rest small— - and poverty go come meet you like tiff,
and your bills go hook you like armed
robber. - Useless pesin and wicked man dey waka
about wit bad-mouth, - he dey cut bad-eyes, he dey use leg give
sign, and he dey point wit hin finger. - Wuru-wuru dey for hin heart, he dey
always plan evil, and he dey always cos
kwanta. - Naso wahala go just carry am go sharp-
sharp; kpakpakpa he go scata and notin go fit
save am again. - Na six tins Baba-God no-like;
eehn…seven tins na tufiakwa to am: - eyes wey dey feel-big, tongue wey dey
lie, hand wey dey shed innocent blood, - heart wey dey plan evil tins, leg wey dey
sharp-sharp rush enta evil, - fake witness wey dey tok lie, and pesin
wey dey cos kwanta among brodas.
Warning Make You No Climb Pesin Wife - My pikin, keep wetin your papa tell you,
and no fashi wetin your mama teach you. - Tie dem join your heart forever; tie dem
for your neck. - Dem go lead you wen you dey waka; dem
go watch you wen you dey sleep, wen you
wake up, dem go reason wit you. - Di commandment na lamp, and di law na
light; and di correction of teaching na di way
to life, - . wey go keep you from
wicked woman—and from di sweet-
mouth of ashawo. - No trip for her for your heart becos she
fine, no let her use her eyes hold you for
work. - Ashawo go turn man to bread, and anoda
man wife go kill am. - Abi man fit carry faya for body—wey hin
cloth no go burn? - Abi man fit waka on top of
charcoal—wey hin leg no go burn? - Naso e be for man wey climb anoda man
wife, Baba-God go punish any-pesin wey
touch her. - Nnaa, make una no hate tiff if he steal
from you to chop, as hungry dey kill am. - But if dem catch am, he must pay seven
times, even if he go pay wit everitin wey he
get for hin house. - But man wey climb anoda pesin wife no
get-sense; any-pesin wey do am dey kill hin
own soul. - Wound and disgrace nahin he go get, and
hin shame no go ever komot. - Na jealousy dey make pesin husband
para, and he no go sorry-for pesin wen he dey
revenge. - He no go gree make you settle am; even
plenty gift no go fit cool am down.