Psalm Chapter 126
Tanks-giving Sey We Recover
- Dis na song of rising. Wen Baba-God release di pikin of Zion from chains, we be like pipo wey dey dream.
- Naso awa mouth yakata wit laff, and awa tongue burku wit singing. Naso di nations con tok sey, “Baba-God don do ogbonge tins for dem.”
- Baba-God don do ogbonge tins for us, and body dey sweet us.
- Chai Baba-God, bring back di pipo wey dem catch as prisoners—like streams for di south.
- Those pipo wey dey plant wit tears—go harvest wit songs of happiness.
- Pesin wey dey cry komot go plant seeds, go surely come back wit happiness, and he go carry bunch of food come back.