Psalm Chapter 130
I Dey Hope For Freedom
- Dis na song of rising. Oh Baba-God, na from inside my deep yawa I dey cry to you;
2. Oh Abasi (Baba-God), hear my voice, and make your ears listen to wetin I dey ask for.
3. Oh Baba-God, If to sey you dey write pipo sins for book, who go fit stand?
4. But forgiveness dey for your hand; so dat pipo go dey fear you.
5. I dey wait for Baba-God, my whole soul dey wait, and na inside hin word I dey put my hope.
6. My soul dey wait for Baba-God—pass as vigilante take dey wait make morning reach, yes, I dey wait pass as vigilante take dey wait make morning reach.
7. Oh Israel, put your hope on Baba-God; becos he dey sorry-for pesin, and nahin fit save pesin kpatakpata.
8. Nahin go free Israel from all dia sins.