Psalm Chapter 150

Abeg share

Praise Baba-God

  1. Praise Baba-God! Praise Baba-God inside hin holy-place; praise am inside di big heaven of hin pawa!
  2. Praise am for hin pawaful works; praise am based-on hin ogbonge greatness.
  3. Praise am wit sound of trumpet, praise am wit lute and harp [musical instruments].
  4. Praise am wit sheke-sheke plus dancing, praise am wit strings and flute!
  5. Praise am wit di sound of cymbals. Praise am wit cymbals wey dem dey nack togeda..
  6. Make everitin wey dey breath praise Baba-God. Make una praise Baba-God.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *