- Oracle dey for my heart about wicked pipo sins. Di fear Baba-God no dey dia
eyes at all.
- for hin own eyes, he dey tok beta tins about hin sef.
- Wetin he dey yarn na evil and wayo; dem no like wisdom or like to do good
tins.
- Dem even dey plan evil ontop bed; e don shuuk hand for evil runs.
- Your love, Oh Baba-God, dey reach heaven, your faithfulness dey reach sky.
- Your righteousness be like big mountains, your justice be like great deep. Oh
Baba-God, na you dey protect men and beast.
- Moni no fit buy your love wey no dey fail! Bigmen and poormen dey hide under
the shadow of your wings.
- Dem dey chop belleful for di yanfu-yanfu wey dey your house; you dey give
dem drink from di river wey you like.
- Na inisde you di fountain of life dey; na your light dey show us road.
- Dey continue to show your love to those pipo wey know you, and your
righeousness to pipo wey dey get clean heart.
- Make proud men no match me for ground, or make wicked pipo hand drive
me comot.
- See as wicked pipo don fall down for ground—dem dey for ground and dem
no go fit stand up again!
Post Views: 39