- Why you dey use evil dey make-mouth you mighty man? Why you dey make-
mouth frm morning to eveing, you wey be disgrace for Baba-God eyes?
- Your tongue dey plan scata-scata, una wey dey do wayo be like razor blade wey
dem sharp well-well.
- You like evil instead of good, you like lie-lie instead of to yarn di truth.
- You love tok wey dey shuuk pesin, chai wayo tongue!
- Baba-God must fall your hand scata for ground forever: He go g
korlorbi go up from inside your house con tear you; he go comot you from di land
of di living.
- Righteous pipo fear-fear; dem go laff am con sey, “
- “See di man wey no make Baba-God hin strong-house but he trust hin plenty
moni, he match pipo for ground take to power!”
- But I be like olive tree wey dey prosper for inside Baba-God house; I go trust
Baba-God love wey no dey fail for ever and ever.
- I go praise you forever becos of wetin you don do; I go put my hope for your
name, your name. I go praise you for where your holy-pipo gather put.
Post Views: 49