Psalm Chapter 57

Abeg share
  1. Sorry for me, Oh Baba-God, sorry for me, na inside you my soul dey hide put. I
    go hide for under di shadow of your wings until wahala waka pass.
  1. I cry out to you Baba-God Most High, I cry to Baba-God wey dey fufill hin plan
    for my life.
  2. From dey send from heaven and he save me, he change am for those pipo wey
    dey pursue me like fire. Baba-God send hin love and faithfulness.
  3. I dey for middle of lions; I dey sleep for where wild animal dey—men wey get
    teeth like spear and arrow, men wey dia tongue sharp like sword.
  4. Make your level high, Oh Baba-God, pass di heavens.
  5. Dem throw net for my leg—I fall wit pain. Dem dig hole for my road—but na
    dem con fall inside di hole.
  6. My heart dey for you, Oh Baba-God; I go compose music sing for you.
  7. Soji, my soul!
    Wake up, harp and lyre!
    I go wake for morning up.
  8. I go praise you, Oh Baba-God, among di Nations; I go sing about you for among
    di pipo.
  9. Your love brekete from here reach heaven; your faithfulness reach sky.
  10. Make your level rise, Oh Baba-God, pass heaven; make your glory full di earth.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *