- Shey na wey be rulers dey use una church-mind dey yarn? Una dey una use
clean hand dey judge men well?
- No, for inside your mind you dey plan ojoro, and your hand dey make pipo fight
for di earth.
- Wicked men don spoil from birth; na from belle dem don turn to jaguda and
dem dey tok lie.
- Poison dey dia mouth like venom for snake mouth like cobra wey no dey hear,
- wey no gree hear di music of di jazz-man no mata as he try reach.
- Break di teeth wey dey dia mouth, Oh Baba-God; tear comot, cut di lion sharp
finger, Oh God.
- Make dem vanish like water wey dey flow dey go; make dia arrow no sharp
wen dem draw di bow.
- Like slug wey dey melt as hin dey move dey go, like pikin wey die for hin malee
belle, make dem no ever see sun.
- Dem go sweep badbell pipo comot before your pot go start to dey feel di heat
of di sun, whether di pot green or dry.
- Righteous pipo go dey happy wen Baba-God don revenge for dem, wen dem
use wicked man blood take wash their leg.
- Men go con sey, “Baba-God still dey reward righteous pipo; surely God dey
wey dey judge di earth.”
Post Views: 56