- Free me from my enemies, Oh Baba-God; Protect me from those pipo wey wan
fight me.
- Save me from pipo wey dey do bad-bad tins, and save me from men wey like
blood.
- See as dem dey wait for me for corner! Rugged men gather toghther dey plan
bad for my back wey I no offend or sin against dem, Oh Lord.
- I no do anytin wrong, but dem wan still fight me. Rise up make you epp me;
look my condition!
- Oh Lord God Almighty, di Oga of Israel, soji yourself make you punish all di
Nations; make you no sorry for wicked traitors.
- Dem don come back for evening dey halla like dogs, dem dey skemp upandan
di city.
- See wetin dey comot for dia mouth—sword dey comot from dia lips, and dem
sey, “Who fit hear us?”
- But you, Oh Baba-God, you laff dem, you laff di nations wit big laff.
- Chai my strength, I dey look you; you, Oh Baba-God, na you I dey hide my head
put.
- My God wey I love. Baba-God go go for my front and go let me laff those pipo
wey dey tok bad for my back.
- But no kill dem, Oh Baba-God awa shield or my pipo go forget. Wit your
power, make dem dey waka-waka upandan and make you fall dia hand.
- Becos of di sins wey dem commit wit dia mouth, becos of di yarning from dia
lips, make God catch dem as dem dey make-mouth. Becos of di curses and lies
wey dem dey yarn,
- burn dem wen you dey pkara, burn dem until dia arshes vanish. Naso everi-
pesin for di whole world go know sey na Baba-God dey rule Jacob.
- Dem come back for evening dey halla like dogs, dey skemp di city upanda.
- Dem dey waka upanda for food, dey halla if dem no bellefull.
- But I go sing about your strength, for morning I go sing about your love; na
you be my strong-house, na your body I dey hide my head wen yawa gas.
- Chai my strength, I go sing praises for you; you, Oh Baba-God, na you be my
strong-house, my loving God.
Post Views: 45