- You don fashi us, Oh Baba-Go, you don burst for our head; e don tey wey you
dey pkara—now make you give us beta again!
- You don shake di land, con tear am open; gum di pieces, e don scata.
- You don show your pipo rugged times; you give us shayo wey make us dey
wagawugu.
- You don raise banner for pipo wey fear you—wey go dey cover dem against di
bow.
- Save us and make you epp us wit your right hand, so dat those pipo wey you
love go dey free.
- Baba-God don tok from inside hin holiness: ‘I go happy; I go devide Shechem con measure from bottom of di mountain of Succoth
- Na me get Gilead, na me get Manasseh. Ephraim na my helmet, Judah na my
staff.
- Moab na basin wey I dey wash my hand put, I go throw my sandals for Edom,
na for Philistia I go shout victory”
- Who go carry me go di city wey dey protected? Who go lead me go Edom?
- No be you, Oh Baba-God, you don fashi us and you no gree follow our army
waka again?
- Give us epp to fight awa enemies, for man epp dey useless.
- Wit Baba-God we go win, and he go match our enemies for ground.
Post Views: 62