Psalm Chapter 66

Abeg share
  1. Make una shout wit joy to Baba-God everi-pesin wey dey for di earth!
  2. Sing di glory of hin name; make hin praise get levels!
  3. Tell Baba-God sey, “Your handwork na elele! Your power great well-well sote
    your enemies dey shake for where you dey.
  4. Ever-pesin for di earth dey migwo for you; dem dey sing praises to you, dem
    dey sing prasise to your name.”
  5. Come see wetin Baba-God don do, as di work wey he do for man take dey make
    me wonder!
  6. He turn sea to land, dem use leg pass tru di water—come, make we rejoice for
    am.
  7. Nahin dey rule forever wit hin power, hin eyes dey look di nations—make those
    pipo wey don rebel no raise up against am.
  8. Oh pipo, make una praise awa God, make dem hear di sound of hin praise;
  9. he don keep awa life and he no gree let our leg dror-fall.
  10. You, Oh Baba-God, you test us; you refine us like silver.
  11. You carry us enta prison con put heavy laod for awa back.
  12. You allow men match awa head; we pass tru faya and water and fire, but you
    carry us enta place wey plenty-plenty tin dey.
  13. I go come your temple wit burnt offering, con fufill my promise—
  14. vows wey my lips promise and wey my mouth yarn wen wahala dey for my
    head.
  15. I go sacrifice animal wey be orobor for you and I go use ram do offering; I go
    give you nama plus goats.
  16. All of una wey dey fear Baba-God, make una con listen; make I tell una wetin
    he don do for me.
  17. I cry to am wit my mouth; hin prasies dey for my tongue.
  18. If for inside my heart I like sins, Baba-God for no hear me.
  19. but Baba-God don surely listen con hear my voice wen I pray.
  20. Praise be to Baba-God, wey never fashi my prayer or code hin love for me!

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *