- Make Baba-God stand up and make hin enemies scata; make hin enemies gbess
wen dem see am.
- As breeze take dey blow smoke comot, make you blow comot; as wax take dey
melt wen faya touch am, naso badbelle pipo go pkeme for Baba-God front.
- But make body sweet righteous pipo, and make dem jolly for Baba-God front;
make dem dey happy and make dem joyful
- Sing for Baba-God, sing praises to hin name, cut-cap for am wey dey move wit
clouds—hin name na Baba-God and make you rejoice for hin front.
- He be papa of pipo wey no get papa, na hin dey defend woman wey her
husband don die, na Baba-God for hin holy house.
6.
- Wen you dey for you pipo front, Oh Baba-God, wen you match pass di waste
land,
- di earth shake, heaven pour down rain fall, for Baba-God front, di God for Sinai,
for Baba-God front, di God of Israel.
- You make rain fall brekete, Oh Baba-God; you ginger your inheritance wey don
taya.
- Your pipo settle inside am, and you provide for poor pipo, from your yanfu-
yanfu, Oh Baba-God.
- Great na di pipo wey preach di word wey Baba-God don yarn.
- “Kings and dia army gbess sharp-sharp; sote pipo go share di beta tins wey
dem bin carry follow body come.
- Even wen you sleep around burn-faya, na silver nahin cover di wings, and
shinning gold cover hin feathers.”
- Wen Baba-God almighty scata di kings wey dey di land, he be like wen snow
dey fall for Zalmon.
- Di mountains of Bashan na majestic mountain; di mountain of Bashan rugged
finish.
- Why you dey look wit jealousy, Oh rugged mountains of Bashan, for di
mountain where Baba-God don choose to reign, where Baba-God hinself go stay
forever?
- Baba-God chariots pass ten thousand, and thousands of thousands; Baba-God
don come from Sanai enta inside hin holy-place.
- Wen you ascend go up, you pack prioners follow body; men give you gifts,
even pipo wey don rebel give you gift—so dat you, Oh Baba-God, go fit stay there.
- Praise be to Baba-God, to God wey save us, wey dey epp us carry our load
everiday.
- Awa God na di God wey dey save pesin; Baba-God wey nobody dey control
nahin pesin fit escape pesin from death.
- Baba-God go surely brake hin enemies head, he go shake di crowns of those
pipo wey dey follow dia way of sin.
- God sey, “I go bring dem from Bashan; I go bring dem from di deep-deep sea,
- so dat you go waka ontop of di blood of your enemies, as di tongue of your
dog sef go collect hin own share.”
- Pipo dey see your movement, Oh Baba-God, movement of my God and king
enta hin holy-place.
- Di singers dey for front, afta dem na di musicians, wit the fine girl wey dey
shake di sheke-sheke.
- Praise Baba-God for where hin pipo gather; praise Baba-God for where Israel
pipo gather put.
- E get one small tribe wey dem dey call Benjamine wey dey lead dem, na there
Judah princes plenty put, and there di princes of Zebulun plus Naphtali dey.
- Bring your power come down, Oh Baba-God, show us your strength, as you
don do before, Oh Baba-God.
- Because of your temple wey dey Jerusalem, kings go bring gift come.
- Change am di wild animals wey dey among plants, change am for di plenty
malu wey dey among di calves of Nations. As e sempe, make e bring bars of silver.
Scata di natons wey like war.
- King go end pipo come from Egypt; Cush go sapo herself to Baba-God.
- Sing for Baba-God, Oh kingdom of di earth, sing praise for God,
- To am wey dey move with the sky wey don old, wey dey shout like thunder.
- Make una tok about di power of Baba-God wey hin majesty dey ontop of
Israel.
- You be elele for inside your holy-place; God of Israel dey give power and
strength to hin pipo. Praise be to Baba-God!
Post Views: 63