Psalm Chapter 75
Baba-God Go Judge Wit Hin Church Mind
- To di producer of music. Set am to “No Scata.” Dis na song—Psalm of Asaph. Oh Baba-God, na you we dey give tanks, na youn we dey give tanks, becos your works na ogbonge, we go tok sey your name dey near.
- You tok sey, “Wen I choose di right time, I go judge wit my church-mind.
- Wen di earth plus everi-pesin wey dey inside am start to dey melt, na me dey stand di
pillars gidigbam. - I tell those pipo wey dey make- mouth sey, ‘No dey buga again,’ and to di wicked pipo, ‘No rise your horn go up!
- No dey rise your horn against heaven, or dey make-mouth as you dey do anyhow.’ ”
- Promotion no dey come from di east or west, or from south.
- But na Baba-God dey judge; he dey bring one pesin down, and he dey carry anoda pesin
go up. - Cup dey for Baba-God hand—and di wine dey red, he don mix am wella. He dey pour
am come out, and all di wicked for di earth dey drink am reach di last drop. - But as for me, I go tok about Baba-God forever; I go sing praises to di God of Jacob.
- All di horns [pawa] of wicked pipo go cut komot, but good pipo horns go raise up